Train your inner-voice to be more accurate by studying Nature everyday.
Some of unah, unah inner-voice don dey corrupted by society expectations and traditions like kilรณdรจ
Unah no even know the difference between unah inner-voice from unah outer-voice, unah just dey live Life with unah outer-voice anyhow, because of what people will say and think...
F** those people, no send thier papa, abi nah dem dey feed you, abeg shift, no dey dey concern about wetin people go talk, say or think..
Just live your life to the fullest to please you and you only - but no ooh, you go dey look people, people wey no fit even know there left from their right, nah those kind rubbish people dey denied you things wey you suppose enjoy with your inner-self.....abeg ooh
Nah your life shall....me my life sweet die, i no send anybody papa ooh, anything my inner-voice say, i accept and we analyse am together
And to get good analyses wey align with Nature, you gat to train your inner-voice by studying Nature everyday.
See you tomorrow smashers.
Comments
Post a Comment