Some people life dry sotey when you slide into their dm's, dem no fit reply because thier life too dry.....
And nah that dry life dey lead to their old age...
Immediately you enter thier house, you go dey sense the extension of dryness for thier life, their life dry sotey all they can talk nah to gossip about people instead of to gossip about all Natural things like our Sun, Plants etc...
Laugh wan kill me die....
Omoh...my life is filled with 0.1 dryness, my life nah like action film, if no be two girls today then nah three boys wey i ready to fight and kill if necessary, if no be Okada wey wan come jam me, then nah to dey chill with one of my Suga's
My life sweet...as i balance am
I no dey fear anything - because i know the code to convert fear into motivation.
My life is so balance with dry and oily life repeatedly, but the oily part wey lead to fun, dey 99.1%
So you can say generally
- i'm 0.1% dry and 99.1% oily -
No wonder, when you read my writings, something like Fire go dey burn for your body
& if your body dey close to fire, your sweat go dey come out to make your body oily,
Oily body means no dry skin, no dry skin means say your body go dey young forever. .
I go live forever...
e go shock all of unah
Comments
Post a Comment