So many secrets and knowledge wey unah no know dey, but nah only through humility you go know...
So shey you dey humble to recieve new knowledge repeatedly or you feel say you know everything - well nah your choice
Knowledge no dey finish, e dey recylce day by day
Such knowledge about focusing on the benefits of every bad thing" dey very hard to practice but with time and consistency, e go dey easy for you.
Life sweet when you sabi am...
I just sabi 49% of life and yet i dey bask unlimited happiness like kilodeΓ©
Because when you fit focus on the benefits of any bad things like sadness - it transform swiftly into happiness repeatedly...
Nah simple Universal code but very hard to practice.
Wetin fit make me sad, abeg tell me
- if i loose all my Money with no customer, i get the benefits to enter forest to continue my research to explore the Universe
- if i loose my life, i get the benefits to practice OBE consciousness transfer in an urgent level.
- if i loose my eyes, i get the benefits to create artificial eyes wey go make life unlimited. ..
So tell me, which bad thing won stop me - i go sharperly transform am into benefits.
And the interesting news nah say, this bad, bad things has less chances of happening when you entertain it - entertaining it gives you time to anticipate and solve the bad thing and you will know how to avoid it!
Nah Bad wey come naturally, our Universe dey give us, and such bad means more elevation, it means more Good!
Abi, if them cut my two hands and i use that ginger to connect with people to make extra organic hands for myself as a replacement -
Is that not a big Benefits?
E mean say if person won cut my hands again, i go just dey smile because solution dey to give me new improved hands.
Comments
Post a Comment