It is called Hard for a reason and nah why we gat to focus more on the hard, because something wey hard need more focus than something wey dey soft.
We understand say, Hard are the building blocks of life, we no just dey say 'Soft girl era' we dey say 'Hard girl era"
Because when you focus on the hard, it becomes easy overtime, and something wey hard needs more of our concentration than something wey dey easy
Life sweet.......
Nah why me, Echenou Micheal dey focus on the hard, we fit no do am all in one day ooh, but tomorrow still dey - and tomorrow and forever, everyday repeatedly we are prepared to keep transforming hard things into soft things
So you dey say, God forbid to anything hard - I pity you
Abii no be hard things police man dey do, to keep you safe
Abii, no be hard things mechanic dey do, to fix your vehicle
Abii, no be hard things farmers dey do, to give you food to eat
Abii, no be hard things Traders dey do, to stay for market for hours everyday just to sell food for you to eat
Abii no be hard thing
So why you dey call hard things God forbid
Abii no be hard thing, for Echenou Micheal to loose some of his Website design customers and still smile
So wetin unah dey talk
Hard things nah our ticket to imMortality
Life sweet abeg, when you embrace the hard and the hard becomes normal like water
Life sweet...........................π»
Comments
Post a Comment