Life sweet when you sabi terraform No into Yes - the Yes fit dey for another place, so go find am.
Yes go find am, e go hard ooh..but the harder it takes, the more e go sweet to terraform.
Nah our job everyday be that, to dey terraform hard things into easy things repeatedly.
Sometimes your inner-voice fit tell you to do something wey dey easy to do, but you dey cocky to do the hard, omor just jejely listen to your inner-voice oooh...e get why
Like Day get Night, like Man get Woman, like your Left leg get your Right leg, nah so your Outer-voice get your Inner-voice
Life becomes more easy when you align with your inner-voice
It's inner, it's within, like cells wey dey heal body inside, your inner voice dey heal you inside too, if only you flow with the good and bad it tells you, abi your cells no dey use the good and bad aspect of things you consume to heal you? -
Just pay close attention to it
Not just the good, but both the good and bad, the hard and easy.
Life sweet...
See you tomorrow smasher
Comments
Post a Comment