We ImMortals just dey play with life like Video game - We sabi one rule - we no fit die, we go live forever now and we sabi say in every Night darkness, Morning Light go surely come...Life sweet when you sabi the thing 💛
But to sabi am and apply am in real day to day life, e hard ooh, i no go tell you lie, e hard die - nah why we imMortals just cucuma embrace hard life as a natural part of life, and doing that brings a mighty peace of mind.
Life sweet, when you sabi how to flow with am correctly, just be prepared for anything hard and the truth be say, in every thing hard you face, it can be transform to easy, just like in every Night darktimes we face, it always transform automatically to Light....Life sweet
If them do you bad, transform the bad to good, and focus on the benefits of the bad, because every bad things got benefits.
Me when dem do me bad carry 7boys beat me, i try to defend myself and i fought back, but the Pako and Cutlass wey dem use dey wipe me dey weaken my body, as my body come dey weaken with injuries...... i carry the matter go police station and police invite the boys wey attack me and i transform the bad to good, by collecting Money from those boys for my medicals....Life sweet
Even in heavy injuries, i still dey make Money, ahhh my inner-Voice, we bad ooh - but we no bad reach, we still need to dey improve everyday
Life sweet...we go yarn tomorrow my astronaut Lovers
Comments
Post a Comment